9 I dey pray for di pipol wey yu give mi, bikos dem bi yor own, but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world.
But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
Wen di pipol wey dey keep di pigs si wetin happen, dem run go inside town bigin spread di news.
Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever.
Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.
I nor dey pray for dem alone, but I also dey pray for oda pipol wey go bilive mi thru di word wey dem go tok about mi.
I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.
Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am.
Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day.
So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.
Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.
Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.
Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.
Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.
Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.