7 Naw, dem don know sey evritin wey yu give mi kom from yu,
Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.
Evritin wey my Papa get, na my own, naim make mi tok sey di Spirit go tell una wetin e dey hear from mi.
Evritin wey I get, na yor own and evritin wey yu get, na my own and dem don honor mi.
I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.
bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.
Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.