Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 17:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 I don give yu glory for dis world and I don finish di work wey yu send mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 17:4
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”


Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”


And anytin wey una use my name ask, I go do am, so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin.


Since I dey do wetin my Papa tell mi, di world go know sey I love my Papa. “So make una get up make wi dey go.


If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.


Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).


Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.


Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.


But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.


Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.


But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.


I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ