I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
Make una dey inside mi, so dat I go dey inside una too. As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine, na so una nor go fit bear fruit, unless una dey inside mi.
I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.
God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.
For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.