23 I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”
Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.
I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.
Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.