14 I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world.
I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”
Good pipol nor like doz wey dey do wiked tins and wiked pipol nor like good pipol.
Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too.
Dem ansa, “Wi go fit.” Den Jesus tell dem, “Una go really drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi,
Dem nor bilong to di world, just as misef nor bilong to di world.
bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.
Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.
Jesus ansa dem, “Na groun una from kom, but mi, na heaven I from kom. Una kom from dis world, but I nor kom from dis world.
Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.
So my brodas and sistas, make una nor sopraiz sey dis world pipol hate una.