9 Di Spirit go show dem sey dem dey wrong about sin, bikos dem nor bilive mi.
Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
Wen e kom, e go show pipol for dis world wetin sin, God raitiousness and God judgement, bi.
Before I know di law, I dey alive, but wen I hear God kommandment, sin just enter my life
e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.
Make una make sure sey non of una get bad mind wey go make una nor bilive, so dat una nor go turn against God wey nor dey die.