Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
“Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.
I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.
Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go.