Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.