Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 16:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 16:19
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?


But di disciples nor undastand wetin Jesus tok and fear nor let dem ask am wetin e mean.


“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.


Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too.


“Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi.”


Some still sey, “Wetin e get for mind wen e sey, ‘Time go soon kom?’ Wi nor undastand wetin e dey tok.”


By dat time, una nor go ask mi anytin again. I tell una true word sey, anytin wey una ask my Papa with my name, E go give una.


By dat time, una go fit ask anytin with my name and God go do am for una.


Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too?


Jesus kon tell dem, “I go only stay with una for small time and afta, I go-go meet di Pesin wey send mi.


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ