Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 16:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 “Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 16:16
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.


Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.


Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,


“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.


Dem dey wrong about God raitiousness, bikos I dey go meet my Papa and dem nor go si mi again.


Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.


Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”


“Naw, I dey go meet di Pesin wey send mi kom, but una dey ask mi, ‘Where yu dey go?’


Since I dey kom meet yu, I dey tok all dis tins for di world, so dat dia joy go full well-well.


And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.


Jesus kon tell dem, “I go only stay with una for small time and afta, I go-go meet di Pesin wey send mi.


Na di same apostles e show ensef many time sey, e still dey alive afta di sofa wey e sofa. Dem si am for forty days and e tell dem about God kingdom.


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ