24 If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
John di Baptist kom show una di true road and una nor bilive am. But tax kollectors and ashawo dem bilive am. Even wen una si all dis tins wey I do, una still nor shange una mind kon bilive God.”
Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”
Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’
E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.”
But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
“Israel pipol, make una hear wetin I dey tok, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di man wey God choose and wey e send to una, wey God use do many mirakles and oda wonderful signs for una front, as all of una know,
Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,
Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.