Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 15:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 15:20
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But nobody for Israel go listin to yu, bikos dem nor go even gri listin to mi. All of dem too sturbon and dem nor dey hear word.


“Nobody big pass en tisha and know savant big pass en oga.


Dem ansa, “Wi go fit.” Den Jesus tell dem, “Una go really drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi,


Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.


No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.


Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am.


(By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).


Make I tell una true word, savant nor dey big pass en oga, just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am.


Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am.


Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus, dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.


I dey tell una true word, if anybody follow wetin I dey tish, e nor go die again.”


Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’


Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.


Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”


Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient.


pipol dey ponish us, but God nor let us die; dem dey nak us for groun, but dem nor fit distroy us.


Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.


True-true, anybody wey won live di kind life wey God wont inside Christ, make e know sey e must sofa.


God tell Samuel, “Make yu do evritin wey di pipol ask yu, bikos nor bi yu dem rijet, but na mi dem rijet as dia king.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ