2 E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.
E go kom judge like pesin wey dey wosh and klean silva and gold. Just as pesin wey dey wosh gold and silva so dat dem go klean, na so too, God messenja go wosh di priests, so dat dem go bring betta sakrifice kom give God.
Pesin wey get sometin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenty. But pesin wey nor get anytin, even di small one wey e get, dem go take am from am.
Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
E si one fig tree for road kon waka go where e dey, but e nor si anytin plok, bikos na only leaf di tree get. So e kon tell di tree, “Yu nor go ever bear fruit again!” At wons, di fig tree kon bigin die.
Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
But di ones wey fall for betta groun, na doz wey hear di word kon receive am and bear many fruits, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”
Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again.
Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
Gentile pipol, una bi like branches wey dem add join olive tree. Una don take di place for some branches wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessings, wey di rut dey give.
Naw, una don si how God dey good and harsh. Even doh E dey vex for doz wey fall, E still dey kind to una. And E go always dey kind to una, as long as una dey do wetin E wont. If not, E go rijet una too.
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.