Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 15:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Una go bi my friend if una do wetin I tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 15:14
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.


E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.


Awa Oga God, Yu porshu doz wey dey dis land before kon gi-am to yor friend Abraham and en shidren-shidren Israel, wey bi yor pipol.


So Moses and Aaron do as God kommand dem.


Friendship if put yu for trobol, but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.


I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.


“But Israel na my savant! Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;


But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.


So, I do as God kommand mi. For day time wen dem dey look mi, I pak my load kon karry am like sey I dey go Babilon and for evening, I break di wall with my hand. Den I go out for nite kon karry my load for shoulder and dem still dey look mi.


Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”


“I tell una wey bi my friends, make una nor fear pipol wey fit kill pesin, but dem nor fit do pass dat.


Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.


“If una love mi, una go do wetin I tok.


Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”


“Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.


So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”


And wetin dem rite for God word kon happen, “Abraham bilive wetin God tok and na dat one make am good for God eye, so God kon koll am, en friend.”


To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.


So Rut go where Boaz dey kon do evritin wey en moda-in-law tell am make e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ