13 E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend.
“I tell una wey bi my friends, make una nor fear pipol wey fit kill pesin, but dem nor fit do pass dat.
“Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.
Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.
I don separate mysef from di world for dia sake, so dat dem go fit separate diasef from di world too.
Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.
Dis na wetin make us know wetin love bi: Jesus Christ die for us, so wi suppose sakrifice awa life for awa fellow Christian brodas and sistas.