Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 14:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 14:9
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Abimelek koll Isaak kon sey, “Dis woman na yor wife! Wetin make yu sey, ‘Na my sista e bi?’ ” Isaak ansa, “Na bikos I tink sey somebody fit kill mi just to get am.”


I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,


How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.


Jesus kon ask en disciples, “Una wey nor bilive! How long I go stay with una? How long I go dey bear with una? Make una bring di boy kom meet mi.”


Una wey dey pritend! Una fit tok how di weda go bi, but why una nor fit tok wetin dey happen so?”


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


And di pesin wey si mi, don si God wey send mi.


Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.


But since una don know mi, una go know my Papa too. Naw wey una don know am, una don si am.”


Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?” Jesus ansa dem, “Una nor know mi or my Papa, if to sey una know mi, una for know my Papa too.”


Naw, if wi dey prish sey God raiz Jesus from deat, wetin make some pipol among una dey sey resureshon nor dey?


wey bi sey, even doh en with God na di same, e nor boast about am.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ