“Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”
And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
So, bikos of una, pipol go dey praiz awa Oga God Jesus Christ and akordin to awa God and Oga God Jesus Christ grace, unasef go dey receive en blessing.