25 “I don dey tell una all dis tins since I dey with una.
“I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ.
Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.
But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.
I don tell una naw before e happen, so dat wen e happen, una go bilive mi.
I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.
“I get plenty tins wey I won tell una, but una nor go fit bear dem naw.