Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 14:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 14:24
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jesus tell am, “If yu won dey pafet, go sell evritin wey yu get, den give di money to poor pipol and yu go get betta tins for heaven. Wen yu don do wetin I tok, den make yu kom follow mi.”


Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.


“If una love mi, una go do wetin I tok.


“I don dey tell una all dis tins since I dey with una.


Make I tell yu di trut, wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witness for wetin wi don si with awa eyes, but una nor gri asept wetin wi tok.


Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol.


Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.


En word neva still dey inside una, bikos una nor bilive sey na-im send mi.


Jesus ansa dem, “Wetin I dey tish nor bi my own, but na di Pesin wey send mi, na-im give mi.


As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.


I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”


Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.


Na wetin I si wen I dey with my Papa, naim I dey tell una, so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”


Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ