15 “If una love mi, una go do wetin I tok.
E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.
“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.
Anybody wey nor love Christ, curse dey en head!
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.
Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.
(Na wetin love mean bi dis: make wi dey do wetin God wont.) Na di kommandment bi dis and just as wi hear am from di biginnin; na so wi suppose to follow am.