Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.
Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?” Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.”
But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.