36 Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?” Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.”
“My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
Den some among di disciple kon dey ask each oda, “Wetin e mean wen e sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi bikos I dey go meet my Papa?’ ”