Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 13:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Afta Judas take di bread, devil enter en mind. Jesus kon tell am, “Di tin wey yu won do, make yu go do am kwik-kwik.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 13:27
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”


Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am. Make una send pesin wey go tok against am for kourt.


Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.


Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.


E ask am, “Wetin make di king take dis kind wiked decision?” Den Ariok tell Daniel wetin happen.


e go-go bring seven spirit wey wiked pass am, kom. Dem go enter di pesin kon sidan for der, so di pesin kondishon go kon bad pass as e bi before. Na like dis e go happen to evil pipol for dis time.”


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


Kwik-kwik e rush go meet di king kon tell am wetin e wont, “I wont John di Baptist head for plate naw.”


So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples.


Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy.


(No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat.


Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”


But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ