Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 13:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 John, di disciple wey Jesus love well-well, sidan for en rite hand wen dem dey chop.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 13:23
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and di poor man get only one sheep wey e buy. E dey kare for am and di sheep grow for en house with en shidren. E dey gi-am wetin e dey chop; di sheep dey drink wota with di man cup kon sidan for di man leg. Di sheep bi like pikin to am.


Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.


“Di poor man kon die and angels karry am go where Abraham dey. Di rish man still die too and dem beri am.


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.


Di pipol wey kom salot dem kon sey, “Jesus love dis man well-well o-o.”


(E klear sey Jesus love Marta, Mary and Lazarus well-well.)


So, Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about.


Den John bend en head near Jesus chest kon ask am, “Oga God, who yu dey tok about?”


So wen Jesus si en mama and John, di disciple wey e love well-well stand for der, e kon tell en mama, “Mama, look, dis na yor pikin.”


Den e run go meet Simon Pita and John kon tell dem, “Somebody don karry Jesus body komot from di grave and wi nor know where dem put am.”


Wen Pita turn round, e kon si John, (di disciple wey Jesus love well-well), dey follow dem. (Dis na di disciple wey bend en head near Jesus chest wen dem dey chop kon ask am, “Oga God, who bi di pesin wey go sell yu give yor enemy?”)


Na dis bi di disciple wey bear witness about all dis tins and wey rite dem and wi know sey wetin e rite, na true.


Den, John, di disciple wey Jesus love kon tell Pita, “Dis man na Jesus o-o.” Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus, e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under), den e jump inside di river.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ