Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 13:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 13:22
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon tell en sons, “Wetin make una dey look each oda?”


As dem dey chop, e kon sey, “I tell una true word, one of una go sell mi.”


Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?”


As dem dey chop for di tabol, Jesus kon sey, “I tell una true word, one of una wey dey chop with mi, go sell mi give my enemies.”


Wetin Jesus tok kon dey worry di disciples for mind, so dem kon dey ask am one-by-one, “Oga God! Na mi?”


“I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol.


So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.


“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’


Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ