17 Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.
So Noah do as God kommand am.
Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem, go get betta reward.
Dis na wetin Moses do akordin to evritin wey God kommand am.
Wen pipol nor follow God way, dem dey waka anyhow, but pipol wey dey obey God law, na happiness bi dia own!
God tell mi, “Make yu go Judah town and Jerusalem street kon tell di pipol sey, ‘Make una listin and obey my kommand!’
I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una.
Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”
Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”
Una go bi my friend if una do wetin I tok.
Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.
So anybody wey know wetin good and e nor do am, don kommit sin bi dat.
God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.