Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.
But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.
But before dat time, I don tink am sey, e good make I send Epafroditus kom meet una. En na my broda, ko-worker and soja. Na una messenja e bi and e dey help mi anytime wey I nid anytin.