Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 13:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 13:14
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair.


Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”


Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.


Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.


Naw, I wont make una know sey, anybody wey God Spirit dey lead, go sey, Jesus naim bi Oga God and e nor go ever curse am.


So, if food wey I dey chop go wound pesin wey dey follow Christ, I nor go ever chop meat again, so dat my brodas and sistas nor go sin.


Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol,


Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


and evry tongue go konfess sey, “Na Jesus Christ bi di Oga God.” Den all di glory go bi God own.


Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again,


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ