“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin.