47 “Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go judge am, bikos I nor kom judge di world, but I kom save pipol for di world.
“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.
Bikos Man Pikin kon save pipol wey lost.
just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”
den en and dem kon go anoda village.
Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.
God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.
“Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite, wey una dey put hope for.
I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”
God dey wait with patient, so dat una go turn from sin kom meet am, just as awa broda Paul rite give una akordin to di wisdom wey God gi-am.
Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.