37 Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.
Jesus kon dey curse all di town where e for do many mirakles, bikos di pipol nor gri turn from sin kom meet God.
“Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
E kom meet en own pipol, but dem nor wont am.
I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
As una get di lite naw, make una bilive am, so dat una go bi lite shidren.” Wen Jesus don tok dis tin finish, e kon komot der go hide.
Dis make wetin Profet Isaya tok happen, wen e sey, “Oga God, wish pipol don bilive wetin wi tok and who God don show en pawa?”
If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.
Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.