Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 12:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 12:34
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom go dey forever.


God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”


All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.


Dem arrest and sey make dem kill-am and nobody kare about am. Dem kill-am, bikos of awa sins.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.


Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’


Doz wey dey weak, go survive and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry, go kon bi one strong nashon. Den mi wey bi God go rule Jerusalem as dia king forever.”


Wen Jesus Christ rish Caesaria for Filippi aria, e kon ask en disciples, “Na who pipol sey Man Pikin bi?”


As Jesus enter Jerusalem, di town skata and pipol kon dey ask, “Who bi dis?”


Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”


Jesus ask dem, “Una law nor tok sey, I sey, ‘Una bi gods?’


But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”


All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’


Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.


Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.


God go ponish evribody bikos of Adam sin. But bikos of di good tins wey Jesus do, God don asept and give us di gift wey dey give life.


but Jesus nor go ever die. So, e go bi priest forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ