Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.
But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.