30 Jesus kon sey, “Dis vois nor tok bikos of mi, but na bikos of una.
I happy sey I nor dey der, so dat una go get anoda shance to bilive mi. Make una kom make wi go si am.”
I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.
(I nor dey trust wetin pipol tok, but I dey tell una dis word make God for save una.)
Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.