For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.
E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.