Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 12:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 “My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 12:27
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?


bikos na so-so trobol full my life and deat don near mi well-well.


But wetin I go tok? God don do as E kommand. All my life, I go dey waka small-small bikos fear dey katch mi.


Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.


For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.


Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”


Den e kon meet di disciples ask dem, “Una still dey sleep and rest? Si, di time don dey rish wen dem go sell Man Pikin give sinnas.


Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.


Since wen I dey with una for di temple una nor arrest mi. But na una time bi dis, di time wey darkness pawa go rule.”


So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.


Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin.


Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”


Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”


Dis na true word and e good for evribody to asept and bilive am sey: “Jesus Christ kom dis world kon save sinnas” and na mi worse pass.


So as di shidren get flesh and blood, en too get flesh and blood like dem, so dat thru deat, e go fit distroy Satan wey get pawa to kill


Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ