‘Bikos dem nor follow mi with all dia heart, no one among dem from twenty years go wey komot from Egypt go si di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob,
“En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’
Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.
Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.
Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!