17 So di pipol wey dey with am wen e wake Lazarus from grave kon tell odas about am.
Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”
Den John bear witness sey, “I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head.
I don si am and I bear witness sey, ‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”
Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik, dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry, so dem follow am.
I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up.
All dis story na true, (bikos na di pesin wey si dem happen, naim tok about dem and wetin e tok na true), so dat una go fit bilive.
Na dis bi di disciple wey bear witness about all dis tins and wey rite dem and wi know sey wetin e rite, na true.
from wen dem baptize am, until e go up leave us; make e kon join us tell pipol di trut sey, Jesus Christ don raiz-up from grave.”
All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.”
and John bear witness for evritin wey e si. Dis na wetin John tok koncerning God word and about Jesus Christ.