So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up.