So I warn dem, “No nid to dey wait for outside till morning. If una try am again, I go ponish una.” From dat time go, dem nor kon dey kom der for Sabat Day.
From den go, half among my men dey work and half dey guide, dem wear war klot and hold spears, shields and bows. And di leaders really support di pipol
Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.