Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 11:51 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

51 (Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 11:51
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And yu go put di Urim and Tummim inside di Breast Plate, so dat anytime wen Aaron dey go meet God, e go wear am for en chest to know wetin dey God mind.


“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.


So God open di donkey mout and di donkey tell Balaam, “Wetin I do yu wey make yu dey beat mi so? Yu don beat mi three times!”


As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.


Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen.


Dem take am go meet Annas, Kaiafas fada-in-law, wey bi di High Priest for dat year.


if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


Christ don save us from di curse wey di law bring, bikos e die for cross for us (just as dem rite am, “Anybody wey dem hang for tree, curse dey en head”),


E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.


Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”


So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ