49 Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen.
Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.
Di priest oga dem and di eldas kon whole meetin with Kaiafas, di High Priest, for en palis.
For dat time, na Annas and Kaiafas bi di High Priests. So God kon tok to John, wey bi Zekaraya pikin, for inside wildaness.
(Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok,
Annas, wey bi di High Priest dey der with Kaiafas, John, Alexanda and some membas for di High Priest family.
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin.