21 Marta tell Jesus, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.
Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”
Dem even tok against God ensef wen dem sey, “God nor fit give us food for di wildaness.
Dem always dey test and shalenge God. Dem dey make di Holy One for Israel dey vex.
As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.”
Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair.
So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.
Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.”
But some among dem sey, “Dis man wey make blind man si, e nor fit do make Lazarus nor die?”