Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.
Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.
But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.