“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
“Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.
Even doh I put shepad make e kare for my sheep, e nor go fit do anytin wen odas dey treaten to distroy di sheep. E nor kare about di ones wey lost or wound or to even feed di odas. Instead, e dey kill di betta ones chop kon trowey di rest part for bush.
Bikos na so Teudas still kom up before, dey tok sey en na pesin wey dey important and na about four hundred pipol follow am. Wen dem kill-am, all di pipol wey dey follow am skata and evritin kon end.