Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 10:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wen e don bring all en sheep kom out, e go-go dia front and di sheep go follow am, bikos dem know en vois.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 10:4
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una listin! My love dey kom. Si! E dey pass di mountins and di hills dey kom meet mi.


I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”


Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.


I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.


My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.


Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out.


Dem nor go gri follow strenja, but dem go run from dem, bikos dem nor know di strenja vois.”


All di pipol wey kom before mi, na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem.


Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.


I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una.


Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well.


Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.


bikos na wetin E koll yu to do, bi dat. Christ sofa as ezample wey una go follow


Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again,


And make una nor dey opress God pipol wey dey under una, instead make una bi ezample to dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ