God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
“Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”
Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.
But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.