‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun.
E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’