Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 10:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 “Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 10:1
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’


God sey, “I nor send all dis profets, but dem dey rush go tok dia own message. I nor tell dem anytin, but dem still dey profesai.


Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


Dem rush enter di town; dey run up-and-down for di wall. Dem klimb kon enter all di house thru window like sey dem bi tif.


“Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.


So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.


Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”


How pesin go prish God word wen God nor send am? As God word sey, “Pipol wey dey prish di Good News dey waka well, bikos na good tins dem dey bring!”


Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.


So wi must stop dem, bikos dem dey tish pipol tins wey go make pipol komot from di trut and dem dey do like dis, bikos of di money wey dem go get.


Nobody dey fit bi High Priest with en pawa bikos e wont make pipol honor am, but na only doz wey God koll to bi priest, just as E koll Aaron.


For dis salvashon matter, di profets wey tok before about di grace wey go kom, try well-well weda dem fit know wetin e mean, but dem nor fit.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.


My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ